VOTE BUYING AND SELLING IN NIGERIA.WORTH 50K😳
Written by INSTINCT AYANFE ADEBAYO
I heard some people saying they are ready to vote for whosoever is ready to distribute money on the election day. (VOTE SELLING)
Omo, let's assume you collect and sell your futuré for 50k, (which can't be possible, se you cut head for them?)
Now! 50k÷8years wey you go use refund am. Given us (#17.123kobo )not even up to #20🤣, Money wey you no fee give my daughter go school make she collect am, she go just laugh and throw it back at you😆😆, se you dey whyne her ni😄😄😄you sef you no go wan give her i trust you, nah the money wey dey wan use buy you be that? You see say dey no know your worth at all
This money una wan collect na investment, if they invest 50k on you during election, trust me if they enter, be ready to pay 100% of it ,abii who go do business wey no go wan gain. That money wey you wan collect Your unborn children sef go pay part of it.
I beg no sell your vote, No sell your children's future.i beg, Let's live the good life we've imagined.
A word is enough, for who? For the wise


No comments:
Post a Comment